You see am gidigba like thing wey no
geti life
You think sai bodi bi wood
See am for hin face and talk you sai
Na him only bi the wood wey do
forest
an’ hin no wan do
na so kon take oppression dey waya am
like to sai hin no bi being
dey show am una yellow pawpaw body to
attract am
as hin dey comot eye sake to sai hin no
wan commit
na so dey do am more more
if hin kon dey push, grip una dey flush
go dey shout yeh! Uhn! Ha! dey weep
like to sai no bi watin you push am do.
the circular veranda wey you dey half
show to see naked,
the back yard wey you dey kari package
do yanga waka
I pity make wahala no fruit for tree,
scatter things for una o
As you dey do am wayo, palava fit tondo
sake to sai bodi no bi wood, just wan
kari bodi hold.
Make na dey do small small if na no want
water pass gari o
an’ kari mouth yarn sai him don spoil na
life.
Bodi No Bi Wood, hin just dey try to
keep bodi ooo.
No comments:
Post a Comment